Pages

Friday, 1 July 2016

FRSC LAGOS CHAPTER YARN SAY TRAFFIC GO YAPA FOR LAGOS-IBADAN EXPRESSROAD FROM TODAY.


The Federal Road Safety Corps, Lagos State Command don yarn say hold-up go plenty for Lagos-Ibadan expressroad from today Friday till Sunday July 3rd, 2016. 
Dem yarn say na from today the the traffic go begin start sake of say many religious body dem go hold service wey go attract many pipu to use the road, plus say the road still dey under maintenance and dat wan go cause go-slow.

Dem say religious bodies like, Redeem, NASFAT & MFM dem go hold serious service from today Friday till Sunday and the service to make plenty pipu pass through the road. Dem dey appeal say make pipu Coperate with dem as dem dey offer alternative routes to reduce the traffic.

See the routes dem, incase U dey plan to go through dat way--

- Lekki – Epe – Ijebu Ode to link Sagamu or
Ibadan
- Lagos – Abeokuta Expressway through Sango
Otta – Owode – Sagamu
Interchange
- Ikorodu – Odogunyan – Sagamu – Ibadan

Dem con yarn say dem don ready 20 patrol vehicles, 5 ambulance, 2 heaven duty tow trucks and 200 officers and men to manage the traffic..

Na HYGINUS OMEJE wey be the sector commander of FRSC, Lagos State sign the statement




No comments: