Saturday, 2 July 2016
ATLAST, GERMANY BEAT ITALY TO QUALIFY ENTER THE SEMI-FINAL FINAL OF EUROS 2016
No be small matta as Germany face Italy for the quarter final of the Euros 2016, the match hot no be small. Italy dey always beat Germany, but Germany change am for dem dis time.
The match wey produce 1-1 draw hold ground as the two teams play like say tomorrow no dey. Na Germany first score thru Ozil, but Boateng hand ball cause penalty wey Bunucci take equalize for Italy.
The game end 1-1 after normal 90 mins, con still drag enter extra time and penalties. Germany play with the determination of beating Italy, as e be say na Italy dey always commot dem from top competitions, Italy don beat Germany reach 8 times to deny dem qualifications to the next round.
The penalty kick dem no easy, as Italy loose 3 penalty kicks, while Germany loose 2 after the normal 5 kicks of the penalty. Emmanuel Nuer stand strong to help save 2 penalty inside the game. Ozil wey score the first goal for Germany con loose him penalty kick.
We must hail the referee, as he hold him ground GIDIGBA say no ojoro go happen inside the match, the referee no hide him yellow card atall as him share reach 9 yellow cards for the two teams, no red card.
As e be, Germany don qualify enter the semi final of the Euros 2016. All the players wey play yesterday, plus goalkeepers na all star and dem prove dem quality becos the match no be small matta.
Congratulations to Germany.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment