Pages

Sunday, 3 July 2016

NA 125 PIPU POOFF INSIDE THE BOMB EXPLOSION WEY HAPPEN FOR BAGHDAD, IRAQ.


At least 125 pipu don pooff and about 150 wound for one explosion wey the so-called Islamic State group for  Baghdad, Iraqi ISIS don claim responsibility. 


Tori dey say na car bomb explosion for one busy street inside Karrada district late on Saturday. The mainly Shia area been dey busy as shoppers late for night becos of  the holy month of Ramadan.

Iraqi PM Haider al-Abadi jam angry crowds wey dey vex as he visit the scene of the explosion on Sunday. He con later declare three days of national mourning.

Another second bomb sef explode for around midnight for Shia area north of the capital, na five people pooff for dat one.
The bombing for Karrada na the deadliest for Iraq dis year.

No comments: