Pages

Wednesday 27 July 2016

ISIS DON WARN LONDON, SAY DEM BE NEXT FOR DEM HIT LIST..


ISIS don warn say na London be the next for dem hit list after yesterday attack wey dem do for one church inside France, after two ISIS fanatical storm one church and pooff the priest.
The threat dey come  just hours after intelligence services warn say attack for the UK is “ dey highly likely” after dem recent atrocities for Europe. Images of threat attacks for
London and other major world capitals don dey posted ontop jihadi messaging app Telegram, according to SITE Intelligence Group.

Security for the British churches din begin tie wrapper  after ISIS knifemen force one  French priest to kneel down before dem slice him throat ontop camera. British counter-terror police don “circulate specific advice” to churches across the UK becos of  fear of similar attack.

No comments: