Pages

Wednesday 27 July 2016

NA JOHN MIKEL GO CAPTAIN TEAM NIGERIA GO THE RIO OLYMPICS.


Chelsea midfielder John Mikel Obi, go be the  captain of Team Nigeria to go 2016 Olympic Games for Rio wey go start on August 5, 2016.
Obi, na one of the three over-aged players wey Siasia invite to join the national U-23 football team for the games, na him first appearance for Olympic Games be dis.

Table tennis star Funke Oshonaike go be the assistant team captain. Dis na Oshonaike’s sixth appearance for the Olympics after she start for Atlanta ’96. The Dream Team VI dey expected to move enter Rio from Atlanta USA on July 29. Other athletes go hopefully leave Nigeria on the same day. Dem choose Mikel Obi and Funke Oshonaike because of their consistency, patriotism and
dedication to national assignments, according to the sport ministry.

But controversy dey ontop him appointment as some pipu feel say Mikel no deserve am, base on say he No get any Olympic experience and he never really achieve anything for the Nigerian team. Some pipu say, Blessing Okagbare for be the captain, base on her experiences and merits for the Nigerian team.. How U see am?



No comments: