Pages

Friday 22 July 2016

NIGER DELTA AVENGERS SAY DEM NO DEY RELATE WITH FG O!


Just 24 hours after President Buhari yarn say him  government don dey run mind with the Niger Delta militants to stop the attacks on oil installations for the region, especially militant group,

Niger Delta Avengers, release a statement ontop dem website say dem no dey aware of such Relations. See dem statement ...

"Our attention don dey drawn to media report say the President dey in touch with
Niger Delta agitators including the Niger Delta Avengers but the truth na be say we No dey aware of any peace talk. If any peace talk dey, e means the President dey talk to dem mercenaries wey wan disturb the genuine struggle of the agitators.

President Buhari government no dey sincere to the Nigeria people and dem foreign allies. If we go engage for any peace talk we go make am clear and the international community must dey part of am. The President know our demands. So make dem stop to dey deceive the international oil companies, the general public and the international community.
Brig.Gen Mudoch Agbinibo Spokesperson





No comments: