Pages

Monday 4 July 2016

POLICE GBAB ONE SOLDIER MAN WEY DEY SMOKE IGBO 'WEED' FOR PUBLIC


Akelebe 'Police' don gbab one Soldier man becos he dey smoke weed for public inside Kermit Mashi, Kaduna State. 

Some eyewitness, say the soldier wey dem code him identity dey always visits the joint to smoke the IGBO. Dem say he dey always cause gbobe and always dey attack anybodi wey challenge am.

Daily Post report say the Akelebe dem gbab the soldier man in the afternoon of Sunday, July 3, 2016. Dem say he wear him military uniform when Akelebe arrest am. Zakari, wey be airtime vendor for mobile network users yarn say, “He dey come here everyday to smoke IGBO”.

“The worst thing na say anytime he comes smoke, he dey aways cause gbobe and heavy trouble. “If you try talk to am, he go beat the hell commot for your bodi”. Daily Post still report say the soldier man try to run as he realize say Akelebe wan gbab am.



No comments: