Pages

Monday, 4 July 2016

THE BOKO HARAM FOR LAGOS, WE DEY CATCH DEM.


General officer commanding (GOC) 81 Division of the Nigerian Army for Lagos, Isidore Edet, on Sunday yarn say the division arrests Boko Haram members wey dey sneak enter Lagos almost everyday.

GOC Edet yarn say some members of the sect run from  the superior power of the military for north-east come run enter Lagos. Na for the inter-denominational service wey dem organize to commemorate the Army celebration day for Saint Charles Lwanga Catholic Church, Ikeja cantonment he for yarn dis yearnings.

He say; “Na Almost everyday, we dey arrest Boko Haram members wey dey run enter Lagos and other places.” “Dem don see say military don dey win the war so dem dey run, but the army in conjunction with other security agencies dey arrest
dem almost everyday.

“Dem dey first deny when we ask dem questions, but when we probe dem more dem go  start yarn where dem fight, how dem kill soldiers, how dey detonated bombs for post office, Maiduguri plus more.  “After we go send dem go give the  higher authorities to do wetin the laws and the constitution of Nigeria go do with them.”

Edet say make the officers and soldiers dey thank God say dem witness another army
celebration day, becos many colleagues don pooff unto the fight against Boko Haram insurgents.




No comments: