Wednesday, 6 July 2016
PORTUGAL BEAT WALES 2-0 TO QUALIFY ENTER FINAL OF THE EUROS 2016
Portugal don enter the final of the European Championship for France. Na the R. Madrid star Cristiano Ronaldo and Nani score the two goals for dem first semi-final to finish Wales’ waka for the competition.
The three-time Ballon d’Or winner Cristiano Ronaldo ginger wella to beat the Welsh defense as he take nod Portugal first goal for inside 50th minute.
Just two minutes after, Nani con connect to one Ronaldo low-drive enter the area to make am two, na so Portugal take win the game for inside 90 mins since the competition don start for France.
Gareth Bale no get chance to show himself as the goalkeeper of Portugal, Rui Patricio just Dey save him shots to deny Bale the chance to score. Now, Portugal go dey wait for the winner of the second semi-final match wey Germany and France go play; many pipu don say the game go be final before final. The second semi-final match go happen on Thursday, July 7.
Congrats to my Ogbonge PIPU dem for Portugal..
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment