Pages

Thursday, 7 July 2016

FRANCE WIPE GERMANY 2-0 TO QUALIFY ENTER FINAL OF THE EUROS


France don book dem spot enter final of Euro 2016 after dem wipe Germany 2-0 on Thursday night. The host nation show dem tactical masterclass as dem score for first half through Antoinne Griezmann, he later make am 2 for second half. 

Germany been  dominate the game sote all French players begin play defense. Draxler, Ozil and Muller try open space for the French Defence, but for where? Na Bastian Schweinsteiger do hand ball for inside the penalty box, na wetin the referee take award penalty give France after him don consult with the linesman. Na Griezmann step up to the penalty kick, and him cool down score the number goal for France.

Paul Pogba make one fine move inside the second half and na dat movement Antonie
Griezmann take score the second goal for France. The match end 2-0 in favor of France, now France go play Portugal wey don already qualify enter Final to knw who go be the Champions of Europe dis season...








No comments: