Wednesday, 13 July 2016
SEE BEATING!! TWO LADIES BEAT ONE MAN ENTER GUTTER BECOS HE CHEAT ON DEM
One young guy wey dey form sharp and smart guy dey date two women for the same area, but e later red for am as the ladies gather wipe am and give am the beating of him life.
The incident happen for Alagbaka area inside Akure, the capital of Ondo State, on Sunday, July 10, 2016, according to eyewitnesses, Dem see the young man as he dey chop the highest humiliation of him life. the ladies dem jump on am beat am yaga-yaga anyhow till he fall enter gutter, behold, the beating continue inside the gutter.
Luku-luku pipu wey gather begin support the ladies dem.
*If u wan be player, abeg play football*lol
Subscribe to:
Post Comments (Atom)


No comments:
Post a Comment