Pages

Wednesday 31 August 2016

“ABEG PRAY FOR JULIUS AGWU” FRIENDS, COLLEAGUES DEY BEG NIGERIANS.


Comedian Julius Agwu dey  undergo wetin him manager call“a routine checkup” for the surgery operation wey he do few months ago for him brain tumor inside London,
he friends and colleagues don send "ABEG" message to Nigerians to help pray for him quick recovery. Media icon, Emma Ogosi, ask about the latest on him health ontop one social media group wey dem call CMC, the group get heavy weight for the entertainment industry for Nigeria, and some of him colleagues say; contrary to wetin him manager yarn say na ‘check up’ Julius needs our prayers dis moment. Initiator of the group, Cornel Udofia post say; “Let us all pray for Julius Genius Agwu.” as dis report show, wishes don dey pour for the quick recovery of Julius the Genius Agwu.

KSolo: I wish him quick recovery and sound health

Chris Odey: it is well with him in Jesus name.

Laura Idam: Wishing him speedy recovey in Jesus Christ name. Amen

Bose Olubo: God please in your infinite mercy, heal Julius in Jesus name we pray…

Muyiwa Akiboye: Jesus Christ, the great healer will surely heal Julius. We shall have great testimony concerning him in Jesus name.

OgbongeYARN sef dey wish U the fastest recovery ever. We wish U sound health Bro. God go see you thru. Amen. 

Gist na from naijaloaded.com




No comments: