Pages

Wednesday 31 August 2016

WHY ME AND JJC CHOOSE TO DO QUIET CODED WEDDING –FUNKE AKINDELE.



Nollywood star actress, Funke Akindele, don explain why her marriage to popular rapper, wey him real name na Abdul Rasheed Bello, aka JJC Skillz, just Dey quiet and coded.
Funke aka Jenifa marry JCC codedly inside London, United Kingdom on August 23 wey be her birthday too. The coded wedding come as which surprise to Nigerians and and only close family members and associates witness the wedding.

The wedding don cement the long rumor about dem relationship matta. But the couple, for one statement wey Funke Akindele publicist, wey he name na Biodun Kupoluyi sign say dey choose to do the  quiet wedding for London becos non of dem wan be the centre of attention base on say dem don dey dat kind lane before.

“The decision to do am coded na just the right thing for us and we pray for the understanding of our close friends and fans for dis offer of a lifetime moment. “For one good time, we go look back in appreciation of divine grace and your support, we go celebrate milestones and where we dey for life. Before the marriage, JJC Skillz na Papa wey get 3 children.

Jenifa, anyhow una choose to do the wedding, we wish una all the best. I pray say the union go longer in real love. Congrats. 
For pipu wey dey vex and hate becos dem no get invite to the wedding, wetin sef, una dim forget say rice don cost now and Nigerians like party? Before u know now, one invitee go invite like five of dem friends wey go carry like two friends each join bodi. Abeg, just Dey happy for dem, dats all. Na who beef epp? 







No comments: