Pages

Saturday 27 August 2016

I KILL MY GIRLFRIEND FOR JUST FOR FUN – BOYFRIEND


22-year-old CHUKWUDI don dey under arrest with the murder of him girlfriend, Adeyeye Nifemi, he say he pooff her for the fun of it, no be for rituals as pipu think.


Chukwudi na National Diploma student of the Rufus Giwa Polytechnic, Owo, Ondo State, he deny say he remove body parts of the girl after he murder her. “I did no remove any part of her body; I only killed her for the fun of it.

We make love together for bush before I pooff her. I am no be cultist. Na when I don pooff her I realize say I don make big mistake and I cry bitterly” na when dem interrogate am for the Ondo state commissioner of Police, Hilda Harrison, wey dem parade the  suspect, he for confess, the  investigations wey dem do show say Chukwudi wey him parents na cassava farmers for Ogbese area of the state, trick him girlfriend go Ayede
Ogbese, about 10 to 15 kilometers away from their campus where he stab her.

He leave her for the bush, as he think say she don pooff, but as he return the next day to Commot some of her body parts, he see say she still dey alive. So he pretend to help her, the suspect carry her to one  camp near one filling station for Ilu Abo, where he con strangle her again. When she no gree die, he nack her head with stones until she finally pooff.  Acting on available intelligence, Police arrest am during interrogation, and he confess to committing the crime. Dem go charge am to court for murder.

Na wa O, pooff ur GIRLFRIEND just for fun? Killing na fun? well I no dey judge O, but I hope dem kill am for fun too. Karma! 






No comments: