Pages

Monday 1 August 2016

IGBOGBO /IKORODU GBEGE AS CULTISTS POOFF ONE NATIVE DOCTOR & 3 OTHERS.


No be small matta for club 24 Road, Igbogbo, Ikorodu area of Lagos State, after suspected cult members pooff four pipu. Na six-man gang storm the community on Friday around 9pm ontop two Okada.
Reports say dem pooff one 63-year- old native doctor, wey he name na Rasheed Yusuf, aka Low Banger, as he dey waka along the road. The cultists dem still shoot Rasheed’s wife, Falilat, and one two-year-old girl, Kehinde. The two survive the attack.

The cultists con later waylaid, shoot and pooff two men, wey be Yusuf Cisco and Lukman Apetu, wey dey show back from work ontop Okada. One other resident sef pooff after plenty shooting spree as some residents sef wound. Policemen from the Ikorodu division and members of one vigilance group (onyabo) for the area don go commot the corpses after the cult boys move.

The cultists still pooff 3 PIPU for grammar school side of Ota-ona inside Ikorodu on saturday too. As on Saturday, most shops and houses for Tobalase and Awotunde Lane, dey locked. One resident say, “Baba (Rasheed), na well known native doctor for dis area, na him son shop he dey waka go for Tobalase Street when he hear the gunshots. He wan go warn him children to lock the doors, before the cultists shoot am. "Dey shoot him wife and one small girl. We rush the woman and the Pikin go one public hospital where dem still dey receive treatments.
“After dem commot from the spot, they shoot and pooff three young men wey dey return from work. One other person pooff for hospital later. Many pipu wound  ontop the spray of bullets from the cultists. One resident, wey give him name just as Qudus, say the cultists enter from the Ebute area of Igbogbo. He say, “The cult guys come from Ikorodu town. We no know the answer gang the boys dem be. Some Onyanbo (vigilance group) members don dey patrol dis area, but dem dey arrest  innocent residents. Na everyday police and the Onyanbo group dey patrol the area, even till now. Igbogbo just get new King, but he go officially resume him duties after the final traditional installation.

Cult Gbege don too much for the town, abi na until pipu pooff finish for the matta before something go happen to stop the matta? Dis cult boys no be spirit now.










No comments: