Pages

Wednesday 17 August 2016

NIGERIA 0-2 GERMANY, NIGERIA STILL GET HOPE OF BRONZE MEDAL.


Germany wipe Nigeria 2-0 inside the semi final match of the Rio 2016 Olympics match wey just end now.
The Germans start to lead with 1 goal for inside first half, the dream team IV no really play with the kind passion wey dem take reach dis level, dem play like say dem don already loose hope as dem passes no even dey perfect and dem finishing sef poor. For the second half, Germany nack another goal enter the Nigerian net to make am 2-0.  The dream team IV go meet Honduras to battle for the bronze medal on saturday.

The match no really dey interesting as I expect and some of the players loose dem self confidence. No player take clear shot, no accurate passes and some players play sluggish game. I hope dem go wake up! 



No comments: