Pages

Wednesday 17 August 2016

NIGERIA Vs GERMANY (Drop Your Predictions and win Cards)


DREAM TEAM IV go face Germany for the semi-final of the Rio 2016 soccer Olympics tournament today Wednesday, August 17 for the Arena Corinthians inside São Paulo.
The dream team hope don high now as dem dey gradually reach gold inside the Olympics after dem top the Group stages to qualify enter quarter final, dem beat Denmark to move enter the semi-final to face Germany today.

The match dey start by 8pm Naija time. Plenty motivation don dey down for the dream team to succeed and beat Germany plus win the gold medal, as one Japanese plastic surgeon billionaire don promise to give the Dream Team IV $30,000 each if dem win gold, & 20,000 for silver ware and $10,000 for bronze medal inside the Rio Olympics as e dey hot. The boys sef don yarn thru the captain, Mikel Obi, say dem go try win gold to celebrate coach Samson Siasia as he complete 49 years old on sunday.

Na wetin go be the score of today match between Nigeria and Germany? Drop ur predictions now!! Get your prediction correct and you fit win recharge card of any network of ur choice. 
Goodluck! 

No comments: