Tuesday, 25 October 2016
APC SAY “NA WE BE THE CAUSE OF NIGERIA ECONOMY HARDSHIP”.
The All Progressives Congress (APC) Don finally admit say na dem dey responsible for the economic challenges wey Nigeria dey go through now.
The party been always dey point accusing finger to the Peoples
Democratic Party (PDP) as the cause of Nigeria recession gbege wey for dey avoided if the party been save for the rainy day.
Na for the meeting wey the APC governors hold for Abuja state house with President Buhari.
According to Premium Times, the new position by the APC to
take responsibility for the current situation dey communicated and dey explained by Governor Rochas Okorocha of Imo wey yarn after the meeting between President Muhammadu Buhari and APC governors.
The meeting hold ground for the Presidential Villa on Monday, October 24. According to speculation, the meeting na also to address the disquiet over the recent ambassadorial nomination wey President Buhari make and some governors dey unhappy say dem no dey consulted before the nominations.,
Subscribe to:
Post Comments (Atom)
No comments:
Post a Comment