Pages

Saturday 22 October 2016

BARCELONA BEAT VALENCIA 3-2, NA MESSI AND SUAREZ SCORE.


Barcelona dey away to Valencia for the match wey produce 5 goals as Barcelona get 3 against Valencia wey be the host.
The goals start with Messi for the first half, but for second half, young Barcelona player Munir wey dey on loan with Valencia con equalize the goal to make am 1-1, four minutes later, Valencia make am 2-1 against Barca. The game drag small before Luis Suarez con get the second goal wey be the equalizer for Barca. Some minutes before full time, Barcelona get penalty through Luis Suarez as dem fall am inside the box 18 of Valencia as he dey try score. NA Messi step up to the penalty and he deliver Barcelona the third goal wey make the total score line to be 3-2 in favor of Barcelona.


No comments: