Pages

Sunday, 23 October 2016

CHELSEA WIPE MANCHESTER UNITED BETA 4-0 TO FALL MOURINHO HAND.


Chelsea no even look dem former coach Jose Mourinho face as dem fall him hand when dem welcome Man U come Stamford Bridge.
Chelsea set record for the match with just 29 seconds to get dem first goal wey Pedro score for inside first half, the goals double as Cahill sef add one join to make am 2-0 before half time whistle. For second half, Chelsea continue dem scoring party as Hazard drive enter the 18 yard box, con fire beta shot to make the goals 3-0. Man utd try dem best to get just one goal, but the Chelsea goal keeper no just give dem chance at all. Like play, like play, new signing, Kante drive enter the 18 yard box to fire shot wey make the goals total 4-0. Man utd no even get any goal for the match.

After the match, Mourinho approach Conte wey be Chelsea coach con yarn say the way he dey celebrate after 4 goals dey humiliating and na falling hand for the coach, but Conte say, dat one no concern am, he own na to ginger the fans to support the fine game wey the team dey play, dats all.

No comments: