Pages

Tuesday 25 October 2016

ONE IGBOGBO WOMAN TIE UP ONE BOY WEY DEY MISS FOR 3DAYS WEY BE HER FRIEND PIKIN FOR HER HOUSE.


One woman now dey under arrest after local vigilante group for Ikorodu, Onyabo Gbe her for kidnapping one teenager wey been dey  miss for three days.
Dem see the boy with him mouth tied up and him hands sef dey tied for her apartment. Gist dey say the woman na friend of the boy mama and the suspect dey stay for Babalola Aroyewun Street, Igbogbo on Saturday, October 22.
According to one resident wey dey coded say  “the boy usually comes to the compound to assist her mother’s friend to fetch water and do other chores. He is a friendly boy who goes about his activities with smiles all over his face. He was declared missing for three days and the case was reported at the Igbogbo Police Station and the Onyabo vigilante group.”
The suspect dey arrested on Saturday morning when her neighbours overhear strange voices from her flat.
The neighbours rush to a check but see say na empty flat with nothing inside, but the strange voices continue and dem sharperly call the suspect wey been dey away from the house at dat point. She, later deny knowledge of the happenings for her flat. The neighbours inform the Police as some strangers show around her flat. The security team rush go the scene con see the boy with him hands and mouth tied inside her flat.

No comments: