Pages

Wednesday, 28 June 2017

NEWS: BADOO don strike again for Ikorodu, pooff full family of 5. see foto


Notorious cult group, Badoo, don strike again for Ikorodu, dis time he pooff one family of five.
Reports dey say, the attack happen for Ayelala, Olopomeji, back of MRS filling station (formerly Kadesh filling station) near the Army Barracks, Odogunyan, Ikorodu, yesterday June 27th. The family wey pooff na from Igede, Benue State but dem dey stay for Odogunyan, Ikorodu. Pipu meet Four of the Five Family members wey don pooff, but the last born still dey alive when pipu see am, but as dem rush am go hospital, the pikin sef poff for the hospital.



No comments: