Pages

Sunday, 25 June 2017

NEWS: Notorious cult group, Badoo, pooff couple to death for Ikorodu.



Notorious cult group, Badoo, on Friday don do another of dem bad work, dis time na one couple for the Idioro area of Ogijo, Ikorodu, Lagos e happen.
No be the first time wey dem dis bad pipu wey be BADOO so dey carry pooff pipu and the pipu of Ikorodu don complain tire, but nothing still dey happen to catch dis BADOO dem. Gist dey say na the dead bodi of the couple dem just see on Friday morning, the neighbour wey see dem say she been don give the couple her phone make dem help her charge am for the uncompleted building wey dem dey stay on Thursday nite.  On Friday morning, as go take the phone, she knock tire and nobody answer, so pipu show to help break the door, just to see say the couple don pooff, dem say dey see grinding stone wey na sign say na the BADOO person pooff the couple. The bodi of the dead couple now don dey mortuary for Sagamu and the grinding stone dey the Ogijo Police Division for more investigation.
Pipu of the area later enter street to stage protest onto the by dis BADOO cult group.

No comments: