Pages

Saturday, 10 June 2017

SPORTS: After One season, Manchester United just drop Zlatan Ibrahimovich.


The Premier League rules say make all clubs submit dem retained and released lists to the Premier League by the third Saturday in May.
The list now don dey public as Premier League clubs from the 2016/17 season don submit the lists of players wey dem wan keep for dem squads, and the ones wey dey comot.
Unfortunately, for Manchester United, Zlatan Ibrahimovich na the only player from the club wey dem drop.
The Premier league still yarn say, 'Please note that players signified as a "free transfer" or released by a club on the expiry of their contract on 30 June 2017, could still remain there next season and so this list should not be seen as definitive for players leaving their club'. For now Zlatan and Manchester United never make any official comments.

*** But Zlatan try for Man U dis season, dem for just give one more year to appreciate wetin he help dem achieve dis season...anyhow sha.

No comments: