Pages

Tuesday 11 July 2017

BREAKING NEWS: 11 don pooff for multiple suicide bomb attacks inside Maiduguri.


News dey say na 11 pipu don pooff for the multiple suicide explosions wey hit Maiduguri, the Borno state capital yesterday night.
Two suicide bombers blow the bombs wey dey dem bodi for Molai Kalamari area inside Maiduguri around 10pm to pooff eight pipu plus demselves.
Another suicide bomber blow for Sabongari Polo area of the state capital, e pooff three pipu
“I cannot specifically tell you whether the suicide bombers were male or female. But we have deployed emergency response team to the scene,” one police source yarn
The injured victims don dey the state specialist hospital where dem dey receive medical attention.

No comments: