Pages

Thursday 6 July 2017

GIST: See Beef: Wizkid Say Davido get Frog Voice.


No be small beef as Davido and Wizkid don make am official, Wizkid Blast Davido for new tweet wey dey trend now.

Yesterday, Davido drop one new song ‘Summer Body’ with Olamide wey he diss Wizkid say:
“With our Yankee passport/Dem say we local/You better catch up/I go see you later,” Davido sing so to tackle Wizkid when Wizkid say brand am as local artist.
Now, Wizkid para for the reply to the song lyrics, he just go twitter to fire back.
“My people make una remember say Yankee passport no be baba blue, e no dey cure frog voice,”
The beef start some weeks ago, after Davido brother, Adewale Adeleke, diss Wizkid by him na Canadian singer The Weeknd’s music. “The Real Starboy”.
Wizkid unfollow Davido for social media na Davido sef vex unfollowing the Starboy, too.

No comments: