Pages

Monday 10 July 2017

NEWS: BRT Don strike for Lagos.


Many pipu for Lagos wake up dis morning to see say the BRT wey dem dey like enter go work no free operate dis morning sake of say the drivers and operators of the Blue Bus Rapid Transport system aka BRT dey on strike.
The strike happen sake of say the operators of the BRT dey owe the drivers dem some months salary.
The strike don affect many commuters as dem no see better transportation to go work, ques full every terminal point as passengers dey wait for BRT to go work. The drivers dem dey demand say make the operators pay dem their full salary or dem no go work.
The matter make some other bus operators like danfo dem to increase transport fare to 100% as e dey hot.
But sha, we hear say dem don resolve the strike after one peaceful resolution among the management wey be Primero, the staffs and drivers. So as e be now, dem don gree to work as the management don promise to pay dem full salary.

No comments: