Pages

Friday, 28 July 2017

NEWS: Hand don gbab 2 Armed Robbers for Zenith Bank, Egbeda, Lagos.


2 Armed Robbers attack one woman just after she make withdrawal for the Zenith Bank branch wey day for Faith Bustop along Egbeda-Ikotun road, on Thursday around
8:30am.
The report na say, the Armed robbers dem dey on bike as dey snatch the woman bag wey the money dey inside, but hand gbab dem as another police officer wey dey another bank for the area shoot one of the robbers pooff. As the other one dey try escape, he run enter middle of pipu so dat dem no go recognise am, but pipu still find am out. Pipu rush gather beat nonsense commot from the armed robber bodi, before police come gbe am and the bodi of the other one wey pooff go.


No comments: