Pages

Wednesday 5 July 2017

NEWS: Mob don burn Another suspected Badoo member for Ebute, Ikorodu.


Hand don gbab Another suspected member of the notorious cult, BADOO and mob sharperly burn am to death for Ebute Ipakodo area of Ikorodu town of Lagos early dis morning.
Gist dey say dey see the man with black oil wey him don rub for bodi as e try enter one compound. As dem gbab am, he say him na member of the secret cult BADOO. He say na him and two other guys land the town in the afternoon to check the possible places to attack.
Na the vigilante youths wey dey safeguard the area, catch am.
After him confession, dey pooff am and burn am. Dey say one police officer wey dey around try stop dem, but only him one no fit handle the matta.

Ikorodu dey hot now, so abeg no carry-waka for there o. Be safe

No comments: