Pages

Wednesday 5 July 2017

NEWS: Mob don pooff one Suspected female kidnapper, burn her to death for Ikorodu.


Ikorodu dey hot now o, yesterday some pipu burn one suspected female kidnapper to death for Ikorodu.
The gist na say one man wey dey sell meat and one Aboki wey dey sell fruits for Allinson Junction, near United High School, Ikorodu raise alarm after the 40-year-old woman wey dey act like mad person just go one corner to receive phone call. As dey meet her for questioning, she no fit explain or yarn well, she no fit tell dem who she be, dey hand her over to the Local Vigilante Office. As dem reach there con interrogation start by the Deputy Chairman of the vigilante group.

 Na for There dey see one iPhone 7, one juju ring, and one list wey contains descriptions of children (age range, prices and height) inside her bag.
She confess say she come from Isolo, Lagos, and say she no come alone, say her other accomplice make-way immediately pipu catch her. The Vigilantes call the police to carry the suspect go, but before the police show, mob wey don already gather just maneuver the vigilante grab the woman beat her wella before dem burn her to death unto Jungle Justice. Dey burn the woman with her bag wey the juju, list, ring and every dey together before police show.

No comments: