Pages

Tuesday, 25 July 2017

SPORT: Chelsea coach, Conte don pursue Kenedy go house after he carry yarn about fans for China.


Premier League champions Chelsea don pursue youngster Robert Kenedy to go house from dem pre-season tour onto some kind offensive posts for China.

The Brazilian player cause gbege for China after he yarn  some statement against the Chinese fans, but he later apologize.
Chelsea see the acts as something wey fit bring down the name of the club, and the Blues' coach Antonio Conte don vex pursue am commot from the team camp.
Chelsea don tender apology for Robert Kenedy mistake as the Blues dey Singapore dey prepare for the new Premier League season.
As e be now, reports dey say Chelsea for sack the 21-year-old player from the club after the pre-season tour.

No comments: