Pages

Wednesday 5 July 2017

SPORT: New Lille coach don sack Vincent Enyeama and 10 other players.


Marcelo Bielsa, na the new coach of French Football club, Lille and he don tell former Nigerian goalkeeper Vincent Enyeama and 10 other players say dey no go need dem for the club again.

He say dis na new regime and he no go want the services of the players dem again sake of say he wan build new team wey go favor am. He say no be say na beef o, he just want to restructure tins for the club for betterment of the club. He wish all of the player plus keeper good luck.

No comments: