Pages

Wednesday 9 August 2017

NEWS: See fotos of the Underground kidnapper Den wey dey see for Ijaiye, Lagos Abeokuta Expressway. 2 pipu save, mob burn 2 suspects.


No be small matta yesterday for Ijaiye Ojokoro area of the Lagos Abeokuta Expressway on Tuesday as the pipu for the area shock unto the discovery of ritualist den wey dey underground for the area since 4 years now, and pipu no even know.
The the women wey dey sweep the road side just notice some kind strange waka for the underground gutter, na so dem alert pipu wey later gather to see wetin dey happen. Police later join pipu for the place and na so dem shoot tear-gas inside the underground tunnel to smoke out the suspects dem.

The 2 suspects wey mob catch, na one time dey burn dem alive as the suspects dem say dey beta die dan to confess.
The Mob dem no give chance for police to fit arrest the suspects, becos after plenty beating, the suspects no gree confess and dey say dem go like die than to confess anything.
News dey say na Two victims dey rescue alive from the den as Lagos Police CP Owoseni don vow to rescue other victims.

Police later arrest two ritualists and dey yarn the police say dem na 28 in number inside the tunnel. Dey say dem duty na to pooff any bodi wey dem kidnap enter there and sell the parts for rituals. According to yarnings, the two suspects wey police gbab been try escape from the other far end of the den, na dem yarn say dem don dey run the underground ritual den for more than 4 years now. The suspects presently dey the  Ojokoro police station.

No comments: