Coach of the U20 flying Eagles wey be Emmanuel Amuneke don yarn say the team no dey under any pressure as dem dey prepare to meet Burundi.
The flying Eagles go face Burundi for the first leg, second qualifiers round. Coach Amuneke say the team dey prepared and the players sef know wetin we dey expect from dem, so the Spirit for inside the camp dey high.
He say the team don set individually and collectively as dem dey prepare to make sure say dem do well and make Naija proud. Meanwhile, the U20 still be the defending Champions for now and dem hope to retain dem championship.

No comments:
Post a Comment