Pages

Tuesday, 31 May 2016

NIGERIAN ARMY DON STOP MILITANTS AS DEM WANT BLOW ANOTHER PIPELINE


The Nigerian Army don yarn say dem don stop some militants wey been wan blow Agip Oil pipeline inside Golobokri, Brass Local Government area, Bayelsa State.
Statement wey the Acting Director, Army Public Relations, Sani Usman say the troops from 343 Artillery Regiment of 2 Brigade 82 Division face some hard militants wey carry 2 speed boat wey dem wan use for the attack on sunday.

He yarn say the troops dem face the militants dem wella as dem speed off as some of the militants get gunshot injuries.

Dem yarn say na only one NSCDC personal wey dem attach with the troops dem get small bullet wound, and he don dey recieve and respond to treatment for hospital.

Oga Sani yarn say, the troops go continue to search for the militants wey get bullet wounds as dem know say some of dem go don go dey recieve treatment for local community hospital or inside the creeks dem.

No comments: