Pages

Sunday 12 June 2016

SEE GBEGE! RUSSIAN FANS ATTACK ENGLAND FANS AFTER DEM PLAY 1-1 DRAW.


No be small Gbege inside Stade Velodrome as Russian fans attack England fans after the two countries play 1-1 draw inside the UEFA Europa competition wey dey happen for France.
England been dey lead 1-0 before Russian player, Vasili Berezutski con equalize the goal wey Erik Dier goal to make the score 1-1 for the die minutes of the game. As the referee blow the final whistle, na so Russian fans rush the England fans as Gbege sharperly set for the stadium.

UEFA don condemn the attack and threaten the two countries day dem go pursue dem commot from the competition if dem no fit talk to dem supporters.


No comments: