Pages

Monday 13 June 2016

BURIAL PLANS FOR THE LATE 'BIG BOSS' STEPHEN KESHI DON DEY SET.


No be small tin happen inside the football house of Nigeria as 2 important former coach dem pooff, first na Stephen Keshi den Amodu Shuaibu.
Amodu Shuaibu don enter ground already according to Muslim rights, but Stephen Keshi bodi still dey mortuary as him burial plans don dey set.

We hear say na for Illah wey be Keshi home town for Delta state dem go bury am. The Federal Government, Edo, Delta and Cross River States don dey show interest for the burial ceremony, more States go still join as we dey hear.

Yarnings dey say him children go soon begin fly enter Naija from USA and the super Eagles with captain John Mikel Obi go play one match to honor Keshi as part of the burial ceremony for Abuja.

No comments: