Pages

Monday 13 June 2016

ARSENAL WAN BUY RIYAD MAHREZ FROM LEICESTER CITY


Arsenal sef don join the race of clubs wey go like sign Mahrez too from Leicester City, after the winger performance for last season dey outstanding and help him club win the League.
The Leicester and Algerian star don be hot cake now as clubs like Barcelona and Manchester United dey monitor am, becos dem sef get interest to sign the star.

As e be, na Barcelona still dey strong to sign Mahrez, but he yarn say him dey honored say many big clubs wan sign am, but as e be now, he never make up him mind whether him go still stay Leicester or him go commot, but until den, him just Dey humbled and honored.

*Arsenal don dey price again, Abi dem really wan buy? *

No comments: