Pages

Saturday 18 June 2016

KENYA GAY TEACHER GO SERVE 90YEARS FOR PRISON AFTER HE COLLOBY 10BOYS.


The teacher name na Mugi, 23years and na one primary school for Kiharu constituency area for Kenya he been dey teach.
The teacher go serve 9 years per count, to make am total of 90 years as na 10 boys him colloby for the matter.

The boys age na from 13-16 years old, and dem don testify against the teacher as dem say Mugi na dem teacher and boarding master, but after prep for night, he go con dey touch dem 'john-thomas', and dey kiss dem body.

*abeg, na why he dey cover him face? Him no shame when he dey colloby the boys dem abi? na now wey he go Chop beans for 90years inside prison he con dey shame.. Mtchewww *

No comments: