Pages

Saturday 18 June 2016

PDP GBEGE!! IGP ARASE DON SEAL THE PARTY SECRETARIAT FOR ABUJA


Because of the Gbege wey dey inside PDP onto chairman matta, the Inspector General of Police, Solomon Arase don order say make dem close down PDP Secretariat for Abuja.
Na for inside one meeting wey dem hold for Abuja yonder he for make dis order. He say make the two contenders wey be senator Ali Modu Sheriff and senator Ahmed Makarfi try settle the Gbege within one week before dem go open the party Secretariat for Abuja.

After plenty yarnings inside the meeting, the supporters of the two senators don gree sa dem go arrange 4 pipu from dem side to sitdon do peaceful talk to settle the matta before one week.


No comments: