Pages

Monday 13 June 2016

LASU SUSPEND ONE UNDER GRADUATE BECOS HE SMOKE GBEGBE 'IGBO' FOR SCHOOL


Lagos State University LASU don suspend one second year computer science undergraduate becos he smoke Gbegbe 'Igbo' for inside school. 
The school bulletin wey carry the news code to student name sha, but dem say the vice Chancellor, Prof Olarewaju Fagbohun suspend the student with the power of the school law sector 8 to suspend any student with dat kind behavior.

The student still get time to defend himself for front of the student disciplinary committee of the school. 

The bulletin say na the school security gbab the guy as dem see am carry plenty Gbegbe for body, na so dem carry am go report give the school authorities on May 3rd,2016. 

The VC explain say the suspension no go make the student fit participate inside any of the school activities until after dem hear him appeal. 

*After pipu go dey yarb brymo say he No give person money for school fees.. How U wan take explain dis one, the person wey dey sponsor am go school go happy to hear dis? * 







No comments: