Pages

Tuesday 14 June 2016

LIGHT WAHALA! SEE CHANNELS TV PRESENTER DEY USE POWER BANK LIVE ON AIR.


Dis one na National disgrace and falling hand as the light wahala don cast. Imagine Channels TV presenter dey use power bank charge her phone on National TV Live.
Yesterday senator Shehu Sanni blast the Ministry of Power under the leadership of Babatunde Fashola, and the DISCO say na darkness dem dey distribute give Nigerians, upon the new high electricity tariff wey Fashola introduce.

The foto of the channels tv presenter na heavy proof say the light matta for naija na Fallin hand. As light no dey, she just carry her power bank jeje to charge her phone Live on National TV wey millions of pipu dey watch around the world.

*Chai.. I hope Fashola watch TV dat day.. Well na If light even dey to watch am*



No comments: