Pages

Tuesday 14 June 2016

CRYSTAL PALACE DON SACK TWO FORMER ARSENAL STARS.


Na 2 former Arsenal stars Crystal Palace vex sack commot from dem club after dem bad performance for the season wey just finish so.


Dem say dem no want the services of Emmanuel Adebayor and Chamakh again as dem no help the team at all, especially as dem take loose to Man Utd for the final of the FA cup.

Dem say Adebayor no gree pick form and the money wey dey him head plenty, but he No dey deliver anything since he join the club. Chamakh own na say he No pick form and injury wan kill am for bench, dem dey waste money for him medical plus him weekly wages as him no dey perform for the club.

Now the two players go dey free for market until any club go like sign dem, but as e be, no club dey show interest yet.






No comments: