Pages

Saturday 18 June 2016

OLORI WURAOLA OF IFE SAY MSN AND WOMAN NO FIT DEY EQUAL.


The Olori of Ile-Ife land don yarn say man and woman no fit equal, na for Maryland, USA she for yarn dis yarnings inside one women forum wey dem organise for USA yonder.
She explain say women get dem own role to play as dem role different from men own, she say women no fit be men, women get dem role to play in nation building, but dem most important role na to build a happy family to support dem husband and help build dem household.

She advice women to tap dem inner powers to explore dem sef to fit achieve great things, instead of dem to dey follow men drag as if dem equal.

*U yarn well Olori *





No comments: