Pages

Friday 10 June 2016

PSG WAN SIGN NEYMAR WITH HEAVY MONEY..


Paris Saint-Germain don say dem need Neymar and dem ready spend £153million to buy the Barcelona and Brazilian star player.
PSG dey hope say the signing of Neymar to help replace dem Ogbonge striker Zlatan Ibrahimovic wey we hear say wan go Man Utd. The £153million go buy Neymar release clause wey him get with Barcelona till June 2018.

Neymar agent, Ribeiro yarn say, although Neymar dey happy with Barcelona, the money wey PSG dey offer plenty and Paris na beautiful city wey anybody go like stay plus say PSG na big club wey any player go like play for.

He say the gist fit be reality if the deal work out well.

No comments: