Friday, 8 July 2016
10 WOUND, PROPERTY SPOIL AS HAUSA AND TRADERS CLASH FOR ASABA.
No be small matta for Asaba on Thursday,as traders clash
with Hausa community for Asaba, Delta State.
Reports dey say na 10 pipu wound and plenty property wey worth millions of naira sef follow the destruction. Police spokesperson, Mrs. Celestina
Kalu, confirm the incident.
Yarnings dey say the trouble start for the Hausa Community along Asaba-
Benin Expressway wey pipu know as “Trailers Parking Quarters”, as some Dangote Trailer Drivers and some traders begin argue about parking space, before the matta reach crossfire, as dem begin exchange words, na so Gbege start.
Na Six pipu Akelebe don arrest now and dem dey help with investigation”. Dem say na one angry Hausa trailer driver just pounce ontop one of the traders, con beat and wound her body seriously. Other traders no fit take am, so dem begin quarrel the driver, na so other Hausa driver dem con join the matta wey cause the Gbege. Na just becos of parking space dis Gbege start so.
Things don dey normal for there now sha.
Subscribe to:
Post Comments (Atom)

No comments:
Post a Comment