Pages

Friday, 8 July 2016

CULTISTS POOFF 11 PIPU FOR OGUN TO MARK 7/7 ANNIVERSARY


 Na 11 pipu don pooff as some cult members for Igode and Fatale communities inside Sagamu area of Ogun State. Four pipu sef get injury as the boys dem attack houses and cars for the attack wey last for about 10 hours. 


Dem say the hoodlums na Aye Confraternity members,  as dem begin spray-spray from 11am on Wednesday to mark dem 7/7 anniversary. Na on Thursday dem do grand finale of the anniversary July 7, 2016 for Emuren community.

Dem say the boys dem reach like 25 ontop okada, dem enter Emuren with wielding guns and cutlasses. Their targets na members of the Eye Confraternity, wey be dem rival cult. The boys dem wear masks, pooff three welders wey just Dey come back from work for  one Junction wey be border to  Emuren and Igode.

The cultists dem con enter Fakele community, just begin shoot crowd wey dey watch football match inside one viewing centre, na seven pipu dem pooff there. The community pipu don Halla say moat of the pipu wey the cult boys kill no dey any cult as some of dem get handwork.

Dem say the matta don tire dem, dem yarn say police begin blow siren enter the community na so the Aye boys to run escape. Four pipu, wey wound don dey one hospital for Sagamu. Na Police, army and Onyabo help to quench the Gbege wey don almost dey spread enter Ikorodu side of Lagos.

For now the security for dat side tight as Akelebe dem don restore normalcy there.




No comments: