Pages

Monday 25 July 2016

AHMED MUSA SHINE FOR LEICESTER CITY WITH PRE-SEASON WIN AGAINST CELTIC



Nigerian international, Ahmed Musa dey very impressive for Leicester City for dem penalty shoot-out win over Celtic on Saturday, July 23.

Musa, wey be say na two weeks ago he complete him move wey worth £18million from CSKA Moscow to the current Premier  League champions 'Leicester City. Na for second half dem introduce am as Leicester City con beat Celtic ontop penalties shoot-out for the International Champions Cup game after dem play 1-1 draw.

Riyad Mahrez give Leicester City the lead goal with one fine solo goal before Eoghan O’Connell fire  the post from the edge of the area to equalise for Cletic.
Musa almost score for Leicester as him get one set up from Mahrez , but the pass was show for Musa back, as he don run enter the box wella.

Another Nigerian, Efe Ambrose sef dey the match for Celtic. Na for second half dem bring in the defender for Celtic.

No comments: