Pages

Monday 25 July 2016

WE ATTACK NIGER STATE CATHOLIC CHURCH BECOS MEMBERS DEY DISTURB US WITH MUSIC FOR OUR JUMA'AT PRAYER - SUSPECT


18 year old Abba Usman wey Akelebe arrest for participating inside the July 15th attack by some Muslim youths on St. Philips Catholic Church for Suleja, Niger State,

He say himself and him group attack the church because the church members dey play dem music too loud and e dey disturb dem as dem dey hold their Juma'at service around
the same time. Usman wey come from Manumfachi inside  Katsina State and he No get any fixed address, yarn say dey attack the church becos dey get the effrontery to disturb the peace of the mosque as  prayers dey going on.

“We go the church to teach dem bitter lesson so dat dem no go ever disturb the peace of the mosque again, especially on Friday when we dey pray. Dey get the whole of Sunday to themselves and we No dey  disturbed dem from their own programmes. “all of the us enter the church con vandalise some of their property, while we carry some of dem musical instruments and other valuables.

I carry  two of the microphones with the aim to sell them, but I No get luck as I dem catch me with dem” he yarn as dem dey parade am for Niger state.




No comments: