Pages

Tuesday 26 July 2016

BREAKING NEWS!! MILITANTS DON INVADE IGANDO AS DEM GBEGE WITH POLICE FOR LAGOS.


Militants dey cause gbege around imose and totowu waterside and dem begin shoot heavy gun to Gbege policemen and soldiers.

According to report now, we hear say one police wey dey  attached with igando police
station is don Chop one stray bullet from the militants. Police and Militants begin battle for Igando,Lagos.

The Policemen, Stand GIDIGBA to face the militants with heavy gun battle for igando area of Lagos. News dey say the militants dem storm the area around 4am, begin burst shops and just Dey shoot for air. The hot shootout, don hit three policemen as dem don injure for the battle.

The matta don cause residents of Igando, especially those around Ikejobi Avenue, Ewedogbon Bus Stop to move commot for dem house or hide indoors. Two Rapid Response Squad armoured tanks sef dey involved inside the gun battle with more than 200 residents for the road with security operatives.





No comments: